You dey drop music, but you no dey sell anything. You dey post link, but e no dey convert. The problem be say, you no understand the music sales funnel. Today, make I break down how to sell your music like a real business, in plain Pidgin.
Many artists dey treat music like charity. You go drop song, post link, beg people to stream, but no plan dey, no system dey. You just dey hope say e go blow. The truth be say, music no be luck, music na business. And if you wan grow business, you gats get music sales funnel.
You no go propose to woman wey never even know your name. Same thing for fans. You no go ask person to stream your song when dem never know you exist. You gats carry them pass different levels, from stage one to the end
The first stage of the music sales funnel na awareness.
This na where people first notice you. Your job na to collect attention. No be to promote link yet, just make people know say you dey. Whether na freestyle, skit, studio session, or behind-the-scenes, the goal na to show face and collect reactions. If you run small ad with ₦50K to ₦100K, e fit help you reach fresh eyes. The focus here no be stream, na visibility.
Next na interest.
Person don see you before, maybe once or twice. Now, you go enter their eye again. Drop another content, build on the vibe. Tell short story behind the song, ask them if dem want you to release am. At this point, you dey build connection. From follower to fan, small small.
Then conversion go enter.
By now, dem dey expect the drop. Na here you launch am. Drop the visuals, drop the link, and make sure every post carry strong call to action. Whether na “Link in bio,” “Stream now,” or “Pre-save am,” everything must direct traffic. You go run ad to people wey don already show interest, follow up with screenshots, DMs, and reposts. This na where real numbers dey enter. Streams, playlist adds, algorithm love, everything go align if you execute well.
But the work no end there. If you abandon fans after dem stream your song, you go lose them. Loyalty stage dey very important. You go stay present. Go live, share your story, drop content behind the music, maybe even voice notes or freestyle sessions. This na how streamers turn to believers. This na how you build loyal fanbase like Odumodublvck. People wey go repost you without you asking.
If you still dey jump from link drop to begging for streams, you go suffer. This thing na business, and music sales funnel dey involved. You gats rewire your method.
Most upcoming artists think promotion starts after the song drops, but that thinking na part of the problem. Real artists wey dey grow steady know say the journey start before the release. Dem dey build demand before supply. Dem dey train their audience to expect, engage, and support. This funnel no just help you get streams, it dey train your mindset to approach music like a product, and fans like customers wey need to go through a full experience before dem commit.
So no be just to drop song and dey pray. You need to guide your audience. First, dem go see you. Then, dem go feel you. Then, dem go stream you. Then, dem go ride for you. That na full music sales funnel. The artists wey dey grow fast, no be by luck. Dem no dey freestyle success, dem dey plan am.
If you want make I help you build your full music funnel from visibility to conversion to fanbase growth, send me DM or tap the link to join my course and strategy plan. No be just drop music, sell am like a business. Because when strategy enter music, na there e go start to pay.
If you’re bold enough to hear some brutally honest reasons why you’re not the next big thing yet, Check this OUT